After
Nigerians begin react to wetin military talk wen dem say dem dey monitor social
media, e be like say di Nigerian military don dey sing another tune
.
Major
General John Enenche wey bi Director, Defense Information, wey first talk say
di military dey monitor social media, don change mouth for di second time in
four days. Him say na one "fake" Twitter handle lie say di military
dey monitor social media for Nigeria. To show say im dey serious about wetin im
dey talk, Major General Enenche add say dem don report di "fake"
handle to Twitter make dem block am.
But
dis na how far him talk go fit sweet reach. Trouble be say e be like Major
General Enenche don forget say him appear for one television station in Nigeria
wey dem dey call, Channels TV on August 22.
For
there, wen him dey talk about "National Security: The New Challenge before
security forces," di director, defense information talk say di military
get wetin im call "strategic media centres wey dey monitor social media.
"We
dey monitor social media to be able to pick out and react to di ones wey dey
anti-government, anti-military, anti-security...we go tackle dem
appropriately," na wetin Major General Enenche talk be that.
Now,
him don change mouth again, come talk say di military never say dem dey monitor
social media, at all, at all.
But
dat one still no stop Nigerians from talking how dem feel about dis matter.
Many Nigerians talk say military no get right to dey monitor social media. Dem
talk say dat one fit be say government no wan make people get freedom of
expression again.


No comments:
Post a Comment